Mai piple maka una never wex for me say una never read new tin from mai page, na water come go pass garri wey no come let me come yan una di new tin wey dey for our dis oliypic wey jus pass di tin no bi small mai broder. As una no say afrika talking na for to mak mai piple no watin dey for dem sokoto make dem for no go sokoto go look for am.
Na dat thing come make me african taking fly go for chi chin lung im contry wey dem dey do oliypic say mak i go see watin dey happen for mai friend Chi chin lung and im sister wey dem dey call lun chi lung abeg chines piple make una forgive me if i no write di name well well, but na so i dey hear wen dem call mai friend and im sister. Oh men!.. as mai plane jus fly land for china na so dem begin dey put flower for mai neck wen i come out of di plane wey carri me go deer, piple di opekes for china dem dey e no bi small wow! mai broders dis opekes dem dey no be small if no be say na airport wey dey na so i for dey tia dey go, as I land mai piple for di check place wey dem dey check , dem no chech me at all na di tin wey dem check most na mai Mr tintin wey dey under mai trosa, for di sake of say africa talking mai Mr Tintin dey long small, say like gentul paiton snike wey long small. For dat day i no even ware drose wey fit pack di tin well, so di sake come dey long wen e fell di hotness of di opekes and to mak di tin long well na jus tracksuit wey everi sport piple dey ware na im i ware too, mai broders so na di tin dem dey look wey no even let dem ask for mai passport, I go yan una later watin happen for airport wit di chines opekes dem, make we tak watin dey veri serious mai piple I bin dey read for mani mani forum dem wey dem dey say mak dem sack mai man wey make us come get sliver for football, I no tink say dis piple like dem contry sef, because watin dem dey talk sef no get head, if dem want emploi person for football teaching na dis man bi our best man to do di job. broder di boys dey play no be small me i dey for stadium as dem dey play even sef na me cover di stori for some naija paper dem, dis tin jus show how our language dey useful for our contry wey be say, wen di tin catch our triner for bodi wey na Pidgin im come dey take tak with di players dem, dat tin come sweet mi sote wey sugar no sweet reach am. i go say congrat to our boys dem wey mak us proud for china, mai piple i go dey yan una mai jass for di tori wit me and di chines opekes for airport i go first go ask mai lawyer if l fit continue wit di stori mak una no go veri far ooo because di stori dey come soon, an if anibodi also go oliypic stori mak im too share im stori wit us, all is welcome to mai Blog just feel free like air wey no get full stop, na for una I open di page for, "COMING NEXT CHINES OPEKES" WATCH OUT SEND YOUR STORIES AND COMMENTA NOW!